Joke – Madame, wetin you dey sell?
E get one
lady wen dey sell oranges. She’s physically endowed; hope you understand that
grammer. She arrange fine fine oranges put on a fine tray. Beside that, she
come dress to kill, sorry to sell the oranges. She wear transparent top/blouse when dey show her cleavage. She
come add short skirt and fine footwear to match. She come dress finish, carry
orange put for head.
‘Buy your orange!
‘Buy your
orange!
‘Buy your
orange!’
One guy come
dey waka pass the lady. The guy look the orange, look the lady. He look the
orange, look the lady. The guy confuse. He say:
‘Madame, na
wetin you dey sell?’
The lady
reply:
‘You blind!
You nor dey see wetin I dey sell.’
The guy is
still confused, ‘Madame, na wetin you dey sell?’
The lady
provoke:
‘Abeg, abeg.
You wan buy or not? Which kind question you dey ask? Abeg, I dey hurry. You be
journalist?’
Guy: ‘No, I
be politician.’
Orange
seller: ‘Hmm… Bros! Bros! Na which one you wan buy? I get political discount in
service to the nation!’
©Dr Eugene’s
Column
©Dr Eugene’s
Blogs
Comments